Area to the World

Abeg omo e get wetin I just dey observe eh
For this industry
It's Victor AD na na na it's paper boy yeah
Motivate yourself area
D Erigma

E pain me say na wen I go na hin everywhere burst
People wan know if na true dey check insta blog
Prapas dey throw backie happy wan kill dem die
I say make bar no dey again people go feed dem die
Even rappers wey no dey post my song before
Fake love don put me for their profile pic
They screenshot their DM wen I dey write dem
Say make we make feature see me see problem
Followers don increase go 1.5 m
OAP since morning dey drive me for Fm
My videos wey Soundcity no gree accept
Dey on heavy rotation even my concert
I pray for be but Oluwa forbid
My song go speak for me anyhow e be
Who go better go better na time e go take
Day break everywhere burst for goodness sake

I say tell dem the full story but dem no dey believe o eh
No matter how you watch film the story inside no fit change o
I be dey give dem the full load down but dem no believe o eh
Who God don bless world people no fit change o

Area o area o area o ehh Warri to the world
To the world o to the world o to the world o eh
Area o area o area oo eeeh
To the world o to the world to the world o eeh

I remember wen I no get bar
That year na wen I dey je eba
Madam know me just put soup with 5 eba
No be enjoyment I come na for survival
No where to go wetin man go do
Na around 2 we dey thief fuel from people motor
Dey sell give who get I pass my neighbor
Rechargeable lamp dey listen to to my all man Deebo
As e dey give us gist abt all celebrities
No internet na him be out everything
I remember when I track am for DBS
Give am my jam e no play am e pain my chest
Because I know d stress wen I don go through
No sponsors sef na money wey l save for school
Na hin I take record am wetin man go do
Give up no join am na ballings

I say tell dem the full story but dem no go believe o
No matter how you watch film the story inside no go fit change o
I be dey tell dem the full load down but dem no believe o
Who God don bless world people no fit change o

Area o area o area o eh
To the world o to the world o to the world ooeh
Area o area o area o ehn abeg one love
To the world o to the world oo to the world

Omo see the character
Na only time e go take stammere go call him papa name
Real matters mehn

Motivate your motherfucking self mehn

Curiosità sulla canzone Area to the World di Erigga

Quando è stata rilasciata la canzone “Area to the World” di Erigga?
La canzone Area to the World è stata rilasciata nel 2019, nell’album “The Erigma II”.

Canzoni più popolari di Erigga

Altri artisti di Afrobeats